*Title Dear Future Me*
Dear Future Me, I hope say by the time you dey read this letter, you don finally become the man wey present me dey dream to be. Right now as I dey write this, I dey for one small corner for my room, phone torchlight on because NEPA don take light again. Nothing too dey work for now, but my heart full of hope. I know say life no easy, but I still believe say tomorrow go better. So I decide to write this letter to you, to remind you where we come from.
*1. I Hope You Remember The Struggles*
Future Me, abeg no forget the days when we dey manage one Spaghetti with two people. No forget the days when we dey trek from Mile 1 to Mile 3 because transport money no dey. No forget those nights when we dey cry silently because things no dey go as planned. Those struggles na im mould us. If you don blow now, if you don make am, no use pride take spoil everything. Remember say we suffer before enjoyment come. Help people wey dey where we been dey before.
*2. I Hope You Did Not Give Up On Your Dreams*
As I dey write this now, my biggest dream na to use my writing take change my life and my family own. I dey write for Writer's Arena, I dey hustle everyday. I know say sometimes e be like say nothing dey happen. Future Me, I hope say you no give up. I hope say you still dey write. I hope say you don publish that your first book wey you always talk about. Even if you change career, I hope say na because you find better passion, no be because fear make you quit. Abeg keep that ginger, keep that fire wey dey burn for our chest now.
*3. I Hope You Take Care Of Mama And Papa*
Future Me, if you don get money now, abeg first thing na Mama and Papa. Those people suffer for us. Mama wey dey borrow money take pay our school fees. Papa wey dey work under sun just to make sure we chop. No forget them o. Buy Mama that fine wrapper wey she always admire for market. Build that small house for Papa for village make he no dey worry again. Na dem be our true heroes. No let money or city life make you forget home.
*4. I Hope You Find True Love And Peace*
No be only money be success. I hope say by now you don find peace of mind. I hope say you don find that one person wey go truly love you for who you be, no be for wetin you get. I hope say you don learn to forgive, to love, and to live happy. No let this world change your kind heart. Still dey greet people, still dey help, still dey laugh like this present me wey dey write.
*Conclusion:*
So Future Me, as I dey end this letter, I just want tell you thank you. Thank you for not giving up on us. I know say waka still far, but I trust you. Wherever you dey now, I dey proud of you already. Keep pushing, keep shining, and always remember say that small boy wey dey write with torchlight for Port Harcourt na him be your root.
Writers